FG don ready to carry Nigerians commot from Lebanon

October 7, 2024

The Ministry of Foreign Affairs don talk say over 500 Nigerians don register with Nigerian mission for Lebanon to come back house. The ministry spokesperson, Amb. Eche Abu-Obe, for one statement yesterday, talk say about 2,000 Nigerians dey live for Lebanon, but most of dem never gree come back even after the mission try persuade dem.

Abu-Obe talk say Federal Government don start evacuation process because of the war wey dey happen between Israel and Hezbollah. E still beg Nigerians wey never register to contact the embassy through email info@mfa.gov.ng and warn dem make dem no resist the evacuation plan because the fight dey get worse.

READ MORE RECENT NEWS HERE https://naija102.com/federal-government-don-give-enugu-small-business-owners-n150000-grant-each/

More Posts