Federal Government and Enugu State Government don sign agreement for di 2026 National Sports Festival wey go happen for di Southeast state.
Di agreement, wey Director-General of di National Sports Commission, Bukola Olopade, sign for Federal Government side and Governor Peter Mbah sign for Enugu State side, don officially give Enugu di full hosting rights for di 23rd National Sports Festival.
For di signing ceremony wey happen for Government House, Enugu, Governor Mbah thank di Commission and other sports stakeholders for di trust wey dem put for di state and im administration. E promise say di event go dey unforgettable for di athletes and all sports lovers for Nigeria and beyond.
READ MORE RECENT NEWS HERE https://naija102.com/tanzania-don-denies-marburg-disease-outbreak/