Make we start with basketball matter, where the Nigeria Senior Women’s Basketball Team wey dem dey call D’Tigress, don show pepper for the ongoing Afrobasket Women’s Championship. On Thursday, dem show Rwanda where power dey, as dem win dem with score of 79-48, and so dem don enter another final.
Dis Nigerian team wey don dey control the competition since 2015, neva lose any match for dis tori. Dem dey target to carry dia fourth championship trophy back to Naija. D’Tigress don knack 23 teams back-to-back and dem go jam the winner between Senegal and Mali for the final wey dey on Saturday.
The last time wey dem lose for Women’s Afrobasket na for 2015 against Cameroon, and since dat time, dem no gree fall yakata for ground.