Defence Headquarters don tell Nigerians make dem shine their eye on security, report any criminal matter for their area, and no allow terrorists get free hand for di New Year. Director of Defence Media Operations, Edward Buba, yarn dis one for Abuja, talk say if citizens give useful information, military go take action. E join use the slang ‘no gree for anybody’ wey dey trend among youths. Buba call on Nigerians make dem stand against terrorists, talk say di military goal for 2024 na to find and scatter terrorists from wherever dem dey hide.
-
26, Keffi Street, Off
Awolowo Road, Ikoyi, Lagos -
+234 810 013 0349
09090001905