The Transmission Company of Nigeria (TCN) don confirm say the poor power supply wey Nigerians dey experience na because of shortage of gas.
TCN talk for one statement say the power generation into the grid don dey decrease gradually because of gas constraints wey dey affect the power generating companies.
Dem talk say because of this issue, e don affect the amount of bulk power wey dey available for the grid to transmit go the electricity distribution companies nationwide.
Nigerians don dey complain about low power supply since December 2023.