Sao Tome And Principe Team Don Land Uyo For AFCON Qualifier Against Super Eagles Of Naija.

September 8, 2023

President, Nigeria Football Federation (NFF), Ibrahim Gusau don put hand for chest give Naija pipo say the Super Eagles go take the match against Sao Tome and Principe seriously, even as dem don secure position for the 2024 AFCON qualification. The Super Eagles go lock horn with Sao Tome and Principe on Sunday for one 2024 AFCON qualifier wey no too get importance insyde the Godswill Akpabio Stadium, Uyo. Gusau bin make the promise on Thursday for Abuja as e tok say dem go also use the match ready for the 2026 World Cup qualifiers wey suppose start for November. 21 players including trainers and team members of Sao Tome and Principe Football Association make the trip come Naija for the game wey Naija don already qualify for. 

More Posts