Presido Buhari Tok Say May Dem Look Di Threats Wey Some Explosive Remain Fit Cause For North East region

August 19, 2022

Presido Muhammadu Buhari don direct Ministry of Humanitarian Affairs, Disaster Management and Social Development and dia agencies to sharperly check the threats wey some explosive remnants fit cause for in the North East region.

Him media person, Femi Adesina, tok say oga Presido give the directive for Maiduguri, Borno State, during by the time of World Humanitarian Day 2022, on Thursday.

He yarn say we Presido confam government commitment to reduce the effect of disasters, climate change, insurgency and challenges of Internally Displaced Persons (IDPs), while directing the Ministry and dia agencies to pay particular attention to new new issues wey come outside becos of the return and rehabilitation of Nigerian wey dey displaced in the 13-year of gbege and insurgency for dat region.

On the fight against insurgency, Dem say Presido Buhari don tok plenty times of him directive to security agencies to take the fight to where the criminals dey hide and make sure say dem finish dem kpatakpata.

More Posts