Former Edo State Governor and Senator wey represent Edo North, Adams Oshiomhole, don spark fresh controversy after e openly support make security operatives shoot armed criminals immediately once dem spot dem.
Oshiomhole yarn dis one on Monday during interview for TVC News, as e criticise the position of the Inspector-General of Police, Olatunji Disu, over the recent clarification wey police make concerning “shoot-on-sight” order.
According to Oshiomhole, security agents no suppose dey apologise or dey shakara when dem face armed criminals.
Why dem dey apologise? If you see criminal wey carry weapon, shoot am immediately. No time for story,” Oshiomhole talk.
This statement come after the Nigeria Police Force explain say the IGP no issue any official “shoot-on-sight” order. Police say wetin Disu refer to na Force Order 237, wey clearly state the situations wey police officers fit legally use firearms according to Rules of Engagement.
But Oshiomhole believe say criminals wey carry guns no deserve pity, insisting say security operatives must act fast to protect innocent Nigerians.
The lawmaker also hail the Department of State Services (DSS) for challenging one court judgment wey sentence some convicted criminals to life imprisonment instead of death sentence.
According to am, judges suppose follow the law strictly and no allow personal feelings affect judgment.
When dem ask am wetin fit pose the biggest threat to President Bola Tinubu ahead of the next election, Oshiomhole no waste time point finger at insecurity.
According to am, banditry, kidnapping and terrorism remain the biggest obstacle wey fit affect Tinubu political future if government no tackle am quickly.
The senator call on President Tinubu to put serious pressure on military chiefs and security commanders, giving dem a clear deadline to end insecurity across the country.\
He also stress say government must begin measure the huge money and resources wey dem dey pump into security agencies against the actual results wey Nigerians dey see on ground.




