President Bola Tinubu don declare state of emergency on top food security for Nigeria. Dis na one bold move wey e aim to tackle di current food inflation and crisis for di kontri. Di Presidential Advisory Council, wey Mr. Dele Alake dey lead as Special Adviser to di President on top Special Duties, Communications and Strategy, don yan dis one as dem address newsmen yesterday.
Dem talk say Mr. President don direct make all mata wey concern food and water availability and affordability, as essential things wey pipo need for survival, make dem dey under di National Security Council. Dem talk say Mr. President also order make dem release fertilizers and grains to farmers and households free of charge so as to reduce di effects of fuel subsidy removal.
Our correspondent, Raliat Adenekan, yan say di Presidential aide explain say Federal Government go partner with states to create ranches for those wey ready to provide land, so as to stop open grazing. Dem go also increase security arrangement to protect farms and farmers so dem go fit return back to di farmland without fear of attacks.
Alake still talk say President Tinubu mandate na to increase di percentage of employment wey dey come from agriculture reach about 70% for di long run, by creating between 5 to 10 million more jobs for di large youth population wey Nigeria get