Di President still approve di suspension of Excise Duties escalation for locally made products for our country. Special Adviser to di President on Special Duties, Communication and Strategy, Dele Alake, talk say dis suspension na part of four Executive Orders wey di President sign.
Alake talk say dem make dis decision to reduce the wahala wey Nigerians dey face, especially for di mata of multiple taxation, and to create better environment for local and foreign businessmen.
(Cue In: Alake On Tax 1)
One of di Bills wey dem sign include di Finance Act (Effective Date Variation) Order, 2023, wey don shift di date wey di changes wey dey inside di Act go start from May 23 to September 1, 2023.
Cue In: Alake On Tax 2)