Port Harcourt Refining Company for Rivers State don start operation again as di Federal Government bin promise say dem go make sure dem dey produce refined products for di facility by December 2023. Dis come happen afta over two years wey di Federal Government approve $1.5 billion for di repairs.
Mechanical repair work for di rehabilitation of Warri Refinery Petrochemical Company (WRPC) go finish by January 2024, according to di Minister of State for Petroleum (Oil), Heineken Lokpobiri, and Mele Kyari, wey be di Group Chief Executive Officer of di NNPCL. Dem talk say Warri refinery go begin operation by di end of di first quarter of 2024. Altogether, Nigeria get four refineries for Port Harcourt, Warri, and Kaduna, wey fit process 445,000 barrels per day (bpd).