The Chairman of Senate Committee ontop the Review of the 1999 Constitution wey also be Deputy Presido of the Senate, Ovie Omo-Agege, don lament cry say na only Eleven states don vote and comply with the constitutional amendment wey dem bring out dis year, while twenty-five oda states never even think for dia head to vote.
Senator Omo-Agege tok dis one for the Joint Press Conference ontop constitutional amendments and latest development mata for the National Assembly accused some state governors of putting hand for wetin no concern dem inside mata of state assemblies and using state lawmakers into dia puppets