Oladips don deleted him obituary post for Instagram and post new video

November 24, 2023

Obituary post wey dem post for Oladips Instagram page don waka. Dem don post new video wey show Oladips dey enjoy song from him new album, Superhero Adugbo. Tori bin fly on November 11 say the rapper don kpai based on health matter wey e don dey face for months. But the mata don dey cause confusion as some social media reports talk say him dey alive.

More Posts