NFF Don Target AFCON And WAFCON Titles For Country Senior Teams Next Year. 

October 4, 2023

President of Nigeria Football Federation, Alhaji Ibrahim Musa Gusau, talk say dem get plans to make Super Eagles win AFCON for Cote D’Ivoire and Super Falcons fit carry back WAFCON title wey dem lose for Morocco. E yan this one as e review wetin NFF and the teams don do under im leadership for one year, and im talk about wetin dem dey expect for the next year.

Gusau talk say im board go put serious effort with the secretariat and Federal Ministry of Sports Development to make sure say Super Eagles start well for the 2026 FIFA World Cup qualifiers and sef make dem win the 34th edition of Africa Cup of Nations wey go happen for Cote d’Ivoire early next year. E talk say dem no go waste any FIFA window for friendly matches, and dem don already arrange two matches for Super Eagles this month against Saudi Arabia and Mozambique.

More Posts