Lagos State Government don yan di public say dem dey investigate di matter wey cause di death of two female LAWMA workers wey happun yesterday. Di release wey di Special Adviser to di Governor on Transportation, Hon. Sola Giwa, sign talk say dem dey look into di mata wey cause di two road workers to die as one moto jam dem for Charlie Boy area wey dey go Gbagada, as di driver bin dey run from arrest.
Hon. Giwa talk say dem don dey see results for di investigation, as di driver wey cause di kasala, wey get registration number EPE 984 DV, na traffic offender wey dem don catch with Automatic Number Plate Recognition (ANPR). E promise say dem go catch di driver and di thorough investigation go show wetin cause di sad matter, and dem go yan di public wetin dem find.