ISWAP Say Na Dem Attack Church For Kogi

October 19, 2022

The Islamic State West Africa Province (ISWAP), wey be branch of the Islamic State (ISIS), don use dia mouth tok say na dem attack one church so for Kogi State.

According to tori, dem use gun kill at least two worshippers while three oda pipo seriously wounjor as about six bad guys wey carry gun burst enter one Celestial Church wey dey for Felele area of Lokoja, Kogi State.

The badness happen late Sunday evening, October 16, 2022, for back of NNPC Mega station wey dey for Felele.

According to one Counter Insurgency Expert, Zagazola Makama, ISWAP say na dia men run the mata after dem don hide inside  Okene forest from where dem plan the attacks.

More Posts