Federal High Court Don Fix Date Ontop Tinubu Mata

August 19, 2022

The Federal High Court, Abuja, don fix October 12, 2022, to hear of a mata wey dem dey ask to use disqualify APC Presidential candidate, Bola Ahmed Tinubu from the 2023 election over alleged certificate Forgery.

Justice Obiora Egwuatu fix the date on Thursday, to allow all the parties wey the mata concern to complete the filing of dia process and exchange am, as the law requir before the new date go reach.

While INEC wey be the 1st defendant for the mata, dey ask for time to respond to the suit, nobody come represent APC, despite say dem show proof say dem serve dem concerning letter of service for the suit.

The Judge come order the plaintiff to ready to call dia witnesses on the new date

More Posts