Wetin don come out from fresh budget reports don make plenty people open mouth. Report show say 33 state governments for Nigeria spend at least N512.1 billion between January and June 2026 just to run Government House, Govnors office, convoy waka, protocol matter, security arrangement and official travel.
The shocking part be say, if you join the salary of all the 36 govnors for Nigeria together for six months, the money no even reach N109 million.
According to the report, one govnor official salary na about N503,000 every month, wey go amount to around N3.018 million for six months. But while govnors dey talk say their salary no plenty, the offices wey dem dey control don chop over N512 billion in just half year.
Out of the money, about N420.01 billion enter Government House operations, Govnor office maintenance, executive administration and other official activities. Another N92.09 billion waka enter transport and travel matter, including local and foreign trips.
To put am clear, the total salary of all the govnors na just 0.02 percent of the money wey states spend around the offices and structures wey support dem.
For states wey spend pass, Kogi State carry first with N65.34 billion. Ogun follow with N45.26 billion, while Lagos spend N45.04 billion on Government House and Govnor office expenses.
Kano spend N25.87 billion, Ekiti spend N25.22 billion, while Cross River drop N23.92 billion. Bayelsa, Imo and Enugu too spend billions of naira for the same purpose.
For travel matter, Plateau State carry gold medal after spending N10.11 billion on movement and transportation within six months. Lagos follow with N8.23 billion, while Taraba spend N5.16 billion.
Development economist, Aliyu Ilias, talk say Nigerians dey make mistake anytime dem focus only on govnor salary.
According to am, the real cash no dey the salary slip; e dey inside convoy, security details, protocol package, estacode, foreign trips, maintenance of official residence, office operations and other juicy benefits wey follow political office.
Him come add say na why politics for Nigeria still remain one of the sweetest businesses to enter because the amount wey government dey spend to maintain top offices too high.
The report come at a time wey state governments don begin receive bigger allocations from Federation Account because of Federal Government economic reforms.
This development don make many Nigerians dey ask one serious questions say,If states dey receive more money and billions dey flow for office upkeep and travel, why many roads still bad, hospitals still dey suffer and basic amenities never reach plenty communities?
As e stand now, the report don expose the big difference between wetin govnors officially earn as salary and the massive amount of public money wey taxpayers dey spend every year to maintain the power, comfort and structures wey surround their offices.




