Federal Government don talk say dem go use Education Tax fund the Student Loan Scheme wey dem dey plan to start soon. The Chairman of FIRS, Zacch Adedeji, talk this one during press briefing for the Presidential Villa, Abuja, together with the Executive Secretary of the Board, Dr Akintunde Sawyerr. Adedeji talk say dem dey use the education tax fund support the scheme so that government fit show accountability to the taxpayers for the country.
Sawyerr, wey also talk during the briefing, yan say the process to apply for the loan go dey smooth, and e no go get human interference because dem go dey monitor every action digitally.
Raliat Adenekan, wey be our correspondent, yan say the Executive Secretary talk say the school fees for people wey dem approve go dey paid directly to their institutions. Dem do am like that so that e go prevent Education tourism and capital flights.