Federal Government don talk say dem no get hand for terror wahala for Niger Republic

December 27, 2024

Federal Government don dismiss one viral video wey Niger Republic military leader, General Abdourahamane Tchiani, release, where e accuse Nigeria and France say dem dey join hand to scatter im country.

Minister of Information, Mohammed Idris, talk say Nigeria no ever work with France or any other country to support terrorist wahala or destabilize Niger Republic.

Idris still add say President Bola Tinubu, as di ECOWAS chairman, don keep di door open for Niger Republic to settle di political palava for di sub-region.

E talk say Nigeria go continue to promote peace, harmony, and di historic friendship wey dem get with Niger.

READ MORE RECENT NEWS HERE https://naija102.com/president-tinubu-don-talk-say-no-going-back-on-tax-reform/

More Posts