Serious kasala show face for Upper Iweka, Onitsha, after one big tanka wey carry pẹtrol fall for roadside, block movement and put fear for body of people wey dey pass road.
According to tori, di tanka tumble late Thursday night after e reach one bad side for di road. Na so steering fail, driver lose control and di motor kpafuka for roadside.
Though nobody lose life and nobody wound, di incident still scatter movement for di area as motor people and traders run comot from di place because of fear say pẹtrol fit catch fire or explode.
As di matter happen, authorities quickly block di affected side of di road and divert movement go another route while emergency workers rush enter di scene.
Anambra Fire Service men too no waste time. Dem storm di area with dia equipment and begin spray water round di tanka make any fire danger no get chance to start.
People wey witness di incident tok say driver bin dey struggle pass di damaged part of di road when steering suddenly disappoint am. Before anybody fit shout “hẹn!”, di tanka don tumble enter roadside.
One witness tok say panic grip everybody for di area as traders abandon dia goods while motorists avoid di scene because nobody wan near pẹtrol tanka wey fit turn disaster at any moment.
Spokesman for Anambra Fire Service, Chukwudi Chiketa, confirm di incident and tok say dem quickly mobilise firefighters and machines go di scene to stop any bigger wahala from happening.
According to am, firefighters carry out rescue and clearing operation, secure di area and make sure say road fit return back to normal movement without any danger.
E still tok say dem go continue to keep eye on top di area alongside other authorities to make sure say no further problem show face.




