One lawyer, Inibehe Effiong, don fire back at police oga-kpatakpata, Tunji Disu, over im warning say make Nigerians stop to dey use police officers do social media tori and comedy content.
Di lawyer tok say police no fit dey complain about content matter when dem sef get plenty platform wey dem dey use spread information every day. According to am, police get dia own internet page, radio station and social media handles wey dem dey use push tori come outside.
Dis wahala start after Disu tok say e no happy say people dey always record police officers and turn dem to social media content. E say di habit dey reduce morale for police people.
But Effiong come ask wetin really be “content creation. E tok say if posting information to teach people or open dia eye na content, den police sef dey inside di same business.
According to am, if police fit use internet, radio and other channels spread information, den e important make dem explain wetin exactly dem mean when dem dey talk say people dey use police officers create content.
Di lawyer still ask why police dey always shake body anytime citizens bring out phone record dem for public while dem dey do government work.
E tok say e never really see where recording police officers while dem dey chop food don become common thing for social media as police claim. E challenge police make dem show examples if di problem really dey widespread.
Effiong come stand gidigba say every Nigerian get legal right to record police officers and other security agents whenever dem dey carry out public duty for open place.
According to am, di right dey inside Nigeria constitution, wey allow people freedom to gather, share and spread information.
E tok say dat freedom no stop for mouth alone, as e still cover phone, camera and other electronic gadgets wey people fit use capture wetin dey happen around dem.
Di lawyer insist say recording police officers during public duty no be offence, adding say transparency and accountability fit grow better when citizens fit document wetin security agents dey do for public eye.




