President Bola Tinubu don talk say him government no go back on the new tax reform bill wey dey before National Assembly.
For him first Presidential media chat last night for Lagos, President Tinubu talk say the reforms go benefit the poor and dem start am to remove the influence of colonial rule for Nigeria’s economy.
Our correspondent, Raliat Adenekan wey follow the broadcast report say, President Tinubu also talk say e go address the systemic flaws wey dey cause corruption, and him administration go block all the loopholes. He also talk say dem go provide incentives for citizens to help reduce corruption tendencies.
For security matter, President Tinubu talk say e get full confidence in the work wey him Security Chiefs dey do. He add say the insecurity situation don improve compared to the past government.
The President also reaffirm say him no get any regret about removing the fuel subsidy, explain say the subsidy regime no dey economically sustainable.
READ MORE RECENT NEWS HERE https://naija102.com/federal-government-don-declare-public-holiday-for-christmas-and-new-year/