Federal Government Don Come Beg The Organized Labour Make Dem Drop The Strike Wey Dem Wan Plan Do Round We Country.

September 29, 2023

The Federal Government don come outside to take beg the join body for we country wey dey defend we workers matter for we country (Organized Labour) say make dem drop dea strike wey dem plan do round we country starting from the 3rd of October. Our tori-sabi person, Raliat Adenekan con report gives us say the Plateau State Governor, Caleb Mutfwang along oda Governors wey comot from the National Economic Council meeting con dey give State House Tori-Sabi pipo small tok-tok ontop wetin dem decide from the meeting, e tok say the council don see the things wey dey worry we country pipo and the economic challenges we don dey finish us small-smal, dem con dey ginger the Nigerian Labour Congress and dea younger brother the Trade Union Congress Leaders make dem come back sidon the round table so dem go all fit rub minds together to take find solution to wetin dem want. 

More Posts