The Federal Executive Council don approve the 2025-2027 Medium Term Expenditure Framework and Fiscal Strategy Paper.
After di FEC meeting, Minister of Budget and Economic Planning, Atiku Bagudu, talk say dem estimate say di total expenditure for 2025 go reach N47.9 trillion Naira, and dem go borrow N9.2 trillion Naira for di year.
Bagudu also talk say some key things wey dem go base di 2025-2027 MTEF on go include oil price of $75 per barrel, oil production go dey 2.06 million barrels per day, exchange rate go be 1,400 Naira to 1 US Dollar, and dem dey target 4.6% GDP growth.
READ MORE RECENT NEWS HERE https://naija102.com/edo-queens-don-play-0-0-draw-with-fc-masar-for-caf-womens-champions-league/