The National Union of Air Transport Employees (NUATE) don direct the Aviation Security and Logistics sub-sector to begin immediate strike from today, wey be Wednesday, August 16, 2023, sake of poor salary. Dem put dis one for circular wey dem send give the Director-General of Civil Aviation, Managing Director of Federal Airports Authority of Nigeria, the Commissioner of Police for Airports Command, the Airport Commandant, Director of Department of State Security for Murtala Muhammed International Airport for Lagos Command. The circular wey the General Secretary of NUATE, Comrade Ocheme Aba, sign, yan sey AVSEC graduates dey collect small N30,000 per month. E add sey all di efforts wey dem don do before to negotiate better salary for dia members no work.
-
26, Keffi Street, Off
Awolowo Road, Ikoyi, Lagos -
+234 810 013 0349
09090001905