Zimbabwe Go Host Super Eagles Inside Kigali For 2026 World Cup Qualifier.

October 20, 2023

Nigeria 2026 FIFA World Cup qualifying day two match against the Warriors of Zimbabwe go shele for the Amarhoro Stadium, Kigali, on Monday the 20th of November. The Warriors go host the Super Eagles for one place wey dem go both gree for as dem( the Warriors) no get stadium wey the world football ruling body, FIFA don accept. Zimbabwe just dey shook leg back inside international football after FIFA bin ban dem for 18-months. The Super Eagles go open dea qualifying move with one home match against the Crocodiles of Lesotho on the 13th of November. Rwanda, South Africa and Benin Republic be the oda teams wey dey the group.

More Posts