Unto The AKATA Side; Man Wey Bin Wan Bully US President Joe Biden, Don Peme For FBI Attack.

August 10, 2023

One man wey post violent threats against President Joe Biden and oda officials for internet don kpai as FBI raid im house for Utah on Wednesday. Dem bin wan arrest Craig Robertson as dem get arrest warrant, just some hours before Mr. Biden go visit di state. According to criminal complaint, Robertson bin post threats on Facebook against Mr. Biden and one prosecutor wey dey try Donald Trump for criminal charges. FBI no give more tori about di matter.

More Posts