UN don yan say make military review rules of engagement afta di bombing for Kaduna.

December 7, 2023

UN don tell military make dem review rules of engagement afta di airstrike wey kill at least 85 pipo for Tudun Biri village for Kaduna state on Sunday. Di drone wey army use target bandits hit as residents dey celebrate Maulud festival. UN human rights, Public Information Officer, Seif Magango, talk say e disapprove di attack, and e be di latest of at least four airstrikes wey don cause civilian casualties since 2017. President Bola Ahmed Tinubu don order investigation, and UN dey call on authorities to take steps to protect civilians and review rules of engagement.

More Posts