UN aid don warn say Israel ban on organisation fit cause lost of lives, for Gaza war

October 31, 2024

After Israel stop di United Nations Relief and Works Agency for Palestine Refugees in di Near East (UNRWA) from operating for Israeli soil, di agency warn say di action fit get serious impact for Gaza, di occupied West Bank, and East Jerusalem. UNRWA, wey dey provide healthcare, emergency aid, and education to millions of Palestinian refugees, describe itself as lifeline to Palestinians. But Israel accuse di agency of being infiltrated by Hamas and claim say di agency’s educational programs dey “promote terrorism and hatred.”

Meanwhile, di Arab League announce emergency session today Thursday to address Israel’s decision. Dem talk say Yemen go lead di session, and Jordan request am. Di League’s permanent representatives go gather for di Cairo headquarters to form united response to di ban.

Aid groups warn say no immediate replacement dey for UNRWA, as humanitarian crisis dey worsen and resources dey scarce.

READ MORE RECENT NEWS HERE https://naija102.com/tinubu-don-appoint-oluyede-as-acting-chief-of-army-staff/

More Posts