The Federal Government don praise di outstanding performance of Team Nigeria for di just concluded 13th African Games for Ghana.
Team Nigeria finish second for di medals table behind Egypt with 47 gold, 33 silver, and 40 bronze medals.
Di Minister of Sports Development, Sen. John Owan Enoh, wey deliver President Bola Tinubu’s congratulatory message to di athletes on Sunday for Abuja, describe their performance as commendable.
But di minister still talk say e dey important to start preparation immediately for di 14th African Games wey dem plan to hold for Egypt for 2027 so dat dem fit improve on di performance wey dem get for Ghana.
E also assure say di ministry go continue to prioritize di welfare of Nigerian sports men and women according to international best practices.