Rescue efforts dey go on for Taiwan afta one 7.4 magnitude earthquake hit di island eastern coast, and don kill at least nine pipo, while more than 800 others dey wound.
About 127 pipo dey trap for collapsed tunnels and for mountainous roads along di rugged coastline.
Di earthquake wey e epicentre dey 18km (11 miles) south of Hualien city, but strong shaking dey reach di capital Taipei, wey dey more than 100km away.
Dis na di worst earthquake wey Taiwan don see for 25 years.
E also cause tsunami alerts earlier for nearby Japanese and Philippine islands wey dem later withdraw. E cause serious damage for Hualien, where buildings fall, roads block and train lines disrupt, wey leave di remote region cut off from di rest of Taiwan.
Rescue operations dey go on to reach di 77 pipo wey dey trap for Jinwen and Qingshui tunnels along di road for Hualien. Pictures show how di road outside di Qingshui tunnel just fall commot.
E no clear how long dem go dey trap for inside – and if dem get food and water, or if dem fit communicate with di outside world.