Di Nigerian Super Falcons don enter top 10 for FIFA Women’s World Cup rankings wey just comot.
Dem release dis ranking afta Spain win England with 1-0 for di final of di 2023 Women’s World Cup wey happun on Sunday, August 20, 2023.
Based on FIFA rules, teams wey comot from di competition for similar stage go dey assessed based on di situation wey surround dia elimination.
Super Falcons dey rank higher pass Germany, Brazil, Portugal, and Italy for di list. Nigeria bin comot for di just-concluded World Cup for di round of 16 afta England beat dem for penalties.