Nigeria don secure their ticket for di 2025 Africa Cup of Nations (AFCON) for Morocco after dem draw 1-1 with Benin Republic for Abidjan last night.
Di Super Eagles don remain unbeaten for di AFCON qualification with 11 points as dem dey head into their last game against Rwanda for Uyo on Monday.
Rwanda, wey get 5 points from 5 games after dem lose 1-0 to Libya for Kigali on Thursday, need to beat di Super Eagles for Uyo to still get chance of qualifying. Dem go also need make Libya beat Benin Republic for Tripoli on Monday to climb second place and take di second ticket to di finals from Group D.
READ MORE RECENT NEWS HERE https://naija102.com/neco-don-pay-examiners-their-allowances/