Di Senate don inaugurate one 17-member ad-hoc committee to investigate di Ways and Means and di Anchor Borrowers Programme of di Central Bank of Nigeria.
Di committee get six weeks to investigate and come back wit dia findings. Di move come afta dem decide to investigate di programmes based on monies wey dem give to state governments, manufacturers, aviation, banks, and excess funding for di power sector since 2015 – wey don increase di current debt profile of di country.
During di committee inauguration, di Senate President, Godswill Akpabio, tell di committee make dem no leave any stone unturned as dem dey pursue di truth about di Loans Advances wey total N30 trillion.