President Bola Tinubu ecowas meeting

President Tinubu showcase ECOWAS achievements for AU mid-year meeting.

July 22, 2024

President Tinubu don yarn about ECOWAS achievements for AU mid-year meeting. President Bola Tinubu yesterday chook mouth for African leaders about wetin ECOWAS don achieve. According to statement wey him spokesman Ajuri Ngelale release, Tinubu yarn for Accra, wey be Ghana capital, on Sunday, where he talk about how dem don take $9 million help people wey need am like refugees, internally displaced persons, and asylum seekers. Tinubu still talk say dem don give $4 million to countries wey dey frontline for fight against terrorism, under ECOWAS Counter Terrorism Humanitarian Response. For education matter, dem don set up West African Network of National Academies of Sciences and African Forum for Research and Innovation.

Tinubu add say for health, ECOWAS still dey support women wey get obstetric fistula, empower women wey dey do agribusiness, and dey focus on gender equality for education and green economy.

READ MORE RECENT NEWS HERE https://naija102.com/federal-government-don-debunk-claims-say-dem-wan-sell-universities-to-private-investors/

More Posts