President Tinubu For World Teachers Day, Don Put Hand For Chest Tok Say Teachers Go Get The Reward Wey Dem Really Deserve.

October 6, 2023

President Bola Ahmed Tinubu don talk say im administration dey determined to make sure say Nigerian teachers receive their correct reward. E yarn dis one yesterday for 2023 World Teachers’ Day event for Abuja. President Tinubu, wey bin dey represented by im deputy, Vice President Kashim Shettima, talk say Nigeria future fit dey secure only if dem dey put money for education, empower teachers, and give every pikin the tools to fit reach their dream. Our reporter talk say President talk say e dey sad for the wahala wey Nigerian teachers dey face. But e yarn say anybody wey wan benefit from the Harmonised Retirement Age of Teachers for Nigeria Act 2022 gats dey ready to go back to classroom with the latest teaching skills and techniques.

More Posts