President Tinubu don tell Police make them put security for Rivers Local Government Offices

October 8, 2024

President Tinubu don call on Governor Siminalayi Fubara, political leaders and dem supporters for Rivers State make dem calm down and respect the rule of law.

For statement wey the President release to react to the fresh protest, gunshots, and fire wey happen for some local government council secretariats for Rivers State – wey stop the newly sworn-in chairmen from entering office – e still direct the police make dem restore and maintain peace, law, and order sharp sharp.

Make we no forget say earlier yesterday, the Inspector General of Police, Kayode Egbetokun, don order the withdrawal of police officers wey dey guard the 23 council secretariats.

READ MORE RECENT NEWS HERE https://naija102.com/fg-don-ready-to-carry-nigerians-commot-from-lebanon/

More Posts