President Tinubu don set up Tripartite Economic Advisory Committee

February 26, 2024

President Bola Tinubu don set up one economic advisory committee wey get representatives from Federal and State governments, plus Organised Private Sector. Tinubu talk for one meeting wey e get with some state governors and stakeholders for Abuja.

E yan say e dey vex about the economy wey dey go down and the cost of living wey dey go up. E talk say the aim of the committee na to put extra effort to balance the economy and make sure say Nigerians get the best economic future.

After the meeting, Business Mogul, Alh Aliko Dangote talk say the meeting focus mainly on the economy, food security, and how to create jobs.

E say dem dey find solution to national challenges. Chairman of BUA Group, Abdulsamad Rabiu talk say dem also discuss how dem go take solve the problem of naira wey dey lose value.

Our tori person, Raliat Adenekan talk say Anambra state Governor, Charles Soludo, talk say the committee go dey meet from time to time and go give President recommendations on economic matters.

More Posts