President Bola Tinubu don present 2025 budget wey dem call “Restoration Budget: Securing Peace, Rebuilding Prosperity” give joint session of National Assembly. Di budget na N47.9 trillion.
Tinubu talk say di government plan to raise N34.82 trillion to fund di budget, wit N15.81 trillion set aside for debt servicing. E also explain say N13.08 trillion go cover di budget deficit.
Di President highlight say Defence and Security go chop N4.91 trillion, Health go get N2.48 trillion, while Infrastructure go take N4.06 trillion.
Tinubu also talk say di budget deficit go dey financed mainly through new borrowings.
Our tori pesin, Raliat Adenekan, report say di budget forecast say inflation go reduce from 34.6% to 15% by next year. Di exchange rate sef go improve from N1,700 per dollar to N1,500, and crude oil production go rise to 2.06 million barrels per day.
Meanwhile, di 10th National Assembly don promise say dem no go block any reform bill wey go help Nigeria. Senate President, Godswill Akpabio, and Speaker of di House of Representatives, Tajudeen Abbas, assure President Tinubu say dem go approve di 2025 budget on time.
READ MORE RECENT NEWS HERE https://naija102.com/senate-don-pass-nigerian-insurance-industry-reform-bill-into-law/