President Bola Tinubu don direct say make all government ministries, departments, and agencies dey buy vehicles wey dey use compressed natural gas (CNG).
E yan dis one wen e dey talk with members of di Federal Executive Council (FEC) for di State House on Monday. Tinubu talk say im government no go stop di energy reforms wey dem don start, and e dey ready to make sure say dem use Nigeria gas potential well-well to reduce how much wey people dey spend for transportation and make life better for Nigerians.
Di President talk say im order dey part of di effort to move Nigeria enta cleaner energy use. Im yarn say vehicles wey dey use CNG dey produce less pollution and dem be better option for Nigerians wen wan buy fuel.
Tinubu come direct say make FEC members no bring any memo wey dey ask for traditional petrol vehicles again. E say make dem go back and look for vehicles wey go give value and wey dey use CNG.
For more news https://naija102.com/blog/