President Bola Tinubu don charge di 45 new ministers wey dem inaugurate for di Federal Republic make dem put di interest and welfare of di whole nation and di plenty different pipo wey dey am, before any consideration wey concern dia region or state.
As e dey di inauguration of di new members of di Federal Executive Council (FEC), di President don yan say di responsibility wey di ministers carry now dey very heavy as dem go dey shape policies wey go serious affect di lives of hundreds of millions of Nigerians.
Our tori person, Raliat Adenekan, yan say some of di Ministers wey talk for one interview don promise say dem go serve with competence to make di Renewed Hope manifesto of di government become reality.
President Tinubu bin swear in di new ministers for nine batches with promise say dem go quicken di effort to move di nation forward and make di administration’s better hope for Nigerians show.