President Bola Tinubu has called on Gavi, the Vaccine Alliance, to collaborate with potential Nigerian vaccine manufacturers to ensure equitable access to life-saving vaccines for children and adults

President Tinubu don direct release of funds for vaccine purchase.

April 5, 2024

President Bola Tinubu don yan say make Gavi, di Vaccine Alliance, join hand wit potential Nigerian vaccine manufacturers to make sure say everybody get access to life-saving vaccines for children and adults.

E talk dis one as im dey meet wit delegation from GAVI wey Dr. Sania Nishtar dey lead, for di State House, on Thursday.

President Tinubu yan say partnership on local vaccine production don dey necessary sake of di wahala wey developing countries dey face, especially during di COVID-19 pandemic and other infectious disease outbreaks.

Im direct di Coordinating Minister of Health and Social Welfare, Professor Muhammad Ali Pate, make e work wit di Coordinating Minister of di Economy and Minister of Finance to make sure say dem release di necessary funds for vaccine procurement.

For her side, di GAVI CEO talk say dem dey ready to collaborate wit di Federal Ministry of Health and Social Welfare and she announce say GAVI don commit to provide $250 million grant support to Nigeria, and dem dey ready to address vaccine inequality for Africa.

More Posts