President Tinubu dey insist say fuel subsidy removal na di best interest of Nigeria

April 29, 2024

President Bola Tinubu don yan say im government decision to remove di subsidy on Petroleum Motor Spirit (petrol) na for di beta interest of Nigeria, and to prevent di kontri from fall inside bankruptcy.


As e tok for Sunday during di opening plenary of di World Economic Forum (WEF) for Saudi Arabia, President Tinubu, wey acknowledge di difficulty wey dey follow di decision, talk say di decision na to reset di economy, while im goment don put measures in place to soften di effects of di hardship.


Our correspondent, Raliat Adenekan, report say President Tinubu still yan say part of di many hard decisions of im goment na to allow di naira dey float so dat e go fit compete well with oda currencies and to fight corruption.


Tinubu still add say collaboration and inclusiveness na very important to achieve global food security, address collective challenges, and promote innovation across different interests for beta world wey go dey stable and prosperous.

More Posts