Presido Bola Tinubu don show him support for di $5bn Floating Liquefied Natural Gas (LNG) project wey dem dey plan for our country. E talk dis one afta him meet wit di joint venture partners wey include UTM FLNG, TECHNIP Energies, and JGC Corporation. During di meeting, leader of di delegation, Julius Rone, yan say di project go fit create 7,000 direct jobs and produce 300,000 tons of LPG every year.
Di President give im full support for di project wen im receive di group of joint venture partners for him office, and di Ambassadors of France and Japan join for di meeting.
According to Mr. Julius Rone, dem dey expect di first floating LNG project for Naija to start operation for di first quarter of 2026.