President Bola Tinubu don appeal to Nigerians make dem get patience with him administration as dem dey try reposition the nation’s economy, especially after the removal of subsidy. The President yan dis one when he meet with All Progressives Congress (APC) Youths wey Dayo Israel lead, for the council chambers of the Presidential Villa Abuja. He talk say he sabi the wahala wey dey ground for the economy, and he promise say dem dey put measures for ground to create alternative economic opportunities and palliatives to reduce the sufferings of the people.
Our correspondent, Raliat Adenekan, talk say the President still assure the youths say dem go get their rightful place for him cabinet.