Peter Obi Tok Say Him ‘Obidient movement’ Go Base Dia Campaign On Issues Instead of Personality Attacks

August 18, 2022

The Labour Party presidential candidate, Peter Obi, don assure afrobeat musician, Femi Kuti, say him ‘Obidient movement’ go base dia campaign on issues instead of personality attacks.

The former Anambra governor give the assurance when he carry him two leg go visit the musician, according by one video wey dey online. Others wey dey the meeting include Charly Boy, among others.

Dem say e be like say na the recent gbege wey dey online between the veteran musician and Obi supporters.

Obi don assure tire say him campaign go dey based on everyday mata wey dey affect Nigerians and Nigeria, adding say the recent controversy no be wetin the movement and his ambition stand for.

More Posts