The pupils and teachers wey dem kidnap for Apostolic Faith Montessori School for Emure Ekiti on January 29 don regain their freedom.
The school children don waka comot, but the driver wey dey among the people wey dem carry run, e no survive, dem kill am and burn am.
The Ekiti State Government don confam say the victims don dey released, talk say the pupils and their teachers waka come Elemure Palace around 4 am on February 4.
Dem no talk whether dem pay any ransom, but the kidnappers bin talk say dem need N10 million each before dem go release the 10 victims.
The Ekiti State Governor, Biodun Oyebanji, appreciate President Bola Tinubu for the support wey e give wey lead to the rescue of the victims.
E talk say make the Commissioner for Health and Human Services, Dr. Oyebanji Filani, carry the children go the state Teaching Hospital for Ado Ekiti make dem get proper medical treatment and post-trauma therapy because of the bad experience wey the children get for the kidnappers’ den.