One court for Spain don rule say make dem release the body of the former Angolan president, José Eduardo dos Santos, give him widow and to carry am go back house go bury.
Eduardo dos Santos been no well for some years before he kpai for Barcelona last month at 79 years old.
Since then, serious gbege don dey inside the Dos Santos family, with him daughter, Tchizé dos Santos, prefer a family burial in Spain, while him widow prefer state funeral for Angola – something wey fit influence the country elections wey dey come.
One lawyer say Tchizé dos Santos go appeal against the decision wey the family make for court for Barcelona.