NNPP Don Tell The Person Wey Bin Drag The Presidential Seat For Dem Rabio Kwankwaso And Odas Make Dem Comot The Party For Six Months.

August 30, 2023

Di Board of Trustees (BoT) of New Nigeria Peoples Party don suspend dia candidate for di February 25 presidential election, Sen. Rabiu Musa Kwankwaso, sake of allegations of anti-party activities. Dem still suspend di National Working Committee (NWC) of di party, and dem don appoint new national officers wey go dey in charge. Dr. Agbo Major don dey act as National Chairman and Mr. Ogini Olaposi as acting National Secretary, plus 18 other people. Dem talk say this suspension go last for six months.

But as e take dey, di Kwankwaso group inside di party too no gree carry last. Dem quickly gather for Abuja on Tuesday con hold “NEC meeting” and comot Aniebonam and Major from di party.

More Posts